Elon Musk SpaceX rocket explode and fall from di sky for di second time – BBC News Pidgin

Wetin we call dis Video, Watch: SpaceX rocket spin out of control inside test flight failure

Article information

  • Author, Max Matza
  • Role, BBC News

One SpaceX rocket explode shortly after dem launch am from Texas on Thursday, grounding flights and causing warnings about falling spaceship remains.

SpaceX confirm say di ship wey no get crew bin suffer “one fast unscheduled disassembly” as e dey climb enter space, and lost contact wit di ground.

Di ogbonge SpaceX Starship, di largest rocket wey dem ever create, spin out of control small time after dem launch am. No injuries or damage don dey reported but fotos from pipo from di Caribbean Sea island nations show di remains as e dey rain down from di sky like fire.

Dis na di eighth mission to test di rocket, and im second back to back failure.

Di 123m (403ft) spaceship bin suppose to re-enter Earth orbit over di Indian Ocean after a one-hour flight.

Im Super Heavy booster, wey dey help am comot ground, bin manage successfully to return to di launchpad.

SpaceX, wey dey owned by billionaire Elon Musk, say teams immediately start to co-ordinate with safety officials for “pre-planned contingency responses”.

Di statement add say SpaceX go review data “to better understand [di] root cause” of di misfire and note say di explosion happen after di loss of “several” engines.

“As always, success comes from wetin we learn, and today flight go offer additional lessons to improve Starship reliability.”

Di statement say di remains suppose fall within a pre-planned area and di rocket no contain any toxic materials. Di company also include email and phone number for dose wey believe say dem find any remains of di craft.

Musk never comment on Thursday explosion.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pipo see as di remains dey fall from di sky from Bahamas

Di accident briefly stop flights for several Florida airports, including for Miami and Orlando, over concerns about say di remains dey on fire.

One statement from di Federal Aviation Administration (FAA) say di flights in and out of airports bin dey delayed due to a “space launch incident”.

Di incident follow one test in January, wia di Starship rocket fail minutes after launching from SpaceX Texas facility.

FAA also briefly close airports two months ago, due to di same concerns about falling rocket remains.

After January incident, FAA ground Starship launch dem and note say di incident bin lead to property damage for di Turks and Caicos Islands for di Caribbean.

“Unfortunately dis happen last time too, so we don get some practice now,” SpaceX flight commentator Dan Huot tell reporters for di launch site on Thursday.

Dis latest Starship launch bin happen before FAA finish investigation of January explosion, according to US media reports.

One statement from di government of di Turks and Caicos say dem dey in contact with US authorities and SpaceX and go “continue to keep di public up to date as we work to ensure di safety and security of our Islands”.

Footage on X be like e show rocket remains on fire as e dey fall over di Caribbean Sea. For di Bahamas, pipo post say dem dey find shelter in order to take cover from rocket remains.

Starship na di biggest, most powerful rocket wey dem don ever build, and e dey key to Musk ambition of colonising Mars.

SpaceX Starship spacecraft and Super Heavy rocket – togeda wey dem dey call Starship – dey intend to be fully reusable, di company .tok

Nasa hope to use one modified version of di spaceship as human lunar lander for im Artemis missions to return to di Moon.

For future, Musk want Starship to make long trips to Mars and back – about nine-month trip each time.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *